Aproko News Gather: See All Top News When Happen On 04-09-2015 Ooooh!!
Aproko News Gather: See All Top News When Happen On 04-09-2015 Ooooh!!
Una welcome to to anoda episode of "Waploaded Aproko Daily Recap"
on the news today ,is your favorite boy,no 1 Waploaded aproko aka
Don jazzy accountant,aka cuteboi aka rugged guy
Our headlines today na:
1.see d foto of army oga as him dey lead dem for morning jogging
2.dem don catch cleaner wey carry N53m 4 murtala mohammed airport
3.see waiting no go make my oga don jazzy marry
4.see foto as one tanker bomb for aba
5.see waitin dis 9ja guy do with wood
oya d tori in full
1.see d foto of army oga as him dey lead dem for morning jogging
change don show for 9ja soldiers dem...no be to wear camouflage dey waka
waka or d respect wey dem get but na to be real ogbonge soldier today
d new oga of army Lt Gen Tukur buratia show us how correct soldiers
suppose be. make una check out dis our new commado as him be correct
oga..
make una press here to see d fotos n d full tori
________________________________________________________________________________
2.dem don catch cleaner wey carry N53m 4 murtala mohammed airport
dem don arrest one airport cleaner wey carry $271,135[wey be N53m for 9ja] for murtala
muhammed international airport for lag.
na one airport police arrest am wen he dey try to carry d biggg money pass d place
wey dem take dey check load.
the airport cleaner wey him name na tijani owolabi wey dey work with d pple wey dey
clean d airport as we hear from d airport department..
make u press here for d full tori
_________________________________________________________________________________
3.see waiting no go make my oga don jazzy marry
my oga boss "d don jazzy" wey don dey hide him boo boo from everybody dey always
dey joke say him get boo boo wey her name na onome..
as dem dey interview am about y him no go marry at all him come say him no get idea o
make una press here for d full tori
__________________________________________________________________________________
4.see foto as one tanker bomb for aba
this mo mo like dat kind 9:30am na him one tanker bomb for abayi aba for abia state
according to d person wey dey der wey come send d picture give one of my guy say
dem neva still know waiting cos d blowing...
see more tori as u press here
__________________________________________________________________________________
5.see waitin dis 9ja guy do with wood
see waiting dis boi from uganda do with wood...
him carve range rover with woodn laptop..
this pikin na just 13 years old o...
omo u too much o u try well well...
press here for d full tori
_________________________________________________________________________________
HOW UNA SEE D TODAY TORI NA??ABEG MAKE UNA TALK O I GO HAPPi WELL
WELL TO C UNA COMMENT O
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}