Aproko News Gather: See All Top News When Happen On 02-09-2015 Ooooh!!

Forum 8 years ago

Aproko News Gather: See All Top News When Happen On 02-09-2015 Ooooh!!

Una welcome to to anoda episode of "Waploaded Aproko Daily Recap"
on the news today ,is your favorite boy,no 1 Waploaded aproko aka
Don jazzy accountant,aka cuteboi aka rugged guy

Our headlines today na:

1. oga presido no make any promise 4 100 days wen e enta aso rock

2. after akpabio car crash na so dem fly am go abroad to tream am

3. una know floyd mayweather?? cos dis guy money dey smell make una c
wait e do


4. na wa o dis oga govanor na real guyman see waitin e do

5. oga presido say dem no suppose dey call 9ja poor country base on say
baba God bless us



oya d tori in full

1. oga presido no make any promise 4 100 days wen e enta aso rock


today na him d senior special assistant to our presido for media wey him name
na shehu Garba say na lie for waiting people dey yan yan say our presido go do for 100
days..
him still talk about all dose books dem wey dey say "100 tins wey him go do for 100days"
n d one way say "him covenant wit d 9ja people say all na lie lie
incase u wan read all make u press here

_________________________________________________________________________

2. after akpabio car crash na so dem fly am go abroad to tream am

d former govanor of akwa ibom state wey many survive d crash wey happen on d 31st of last month
don dey abroad for treatment..
i hear say him get injury for chest but dem don fly am go abroad sha
incase u wan read d rest news make u click here
__________________________________________________________________________

3. una know floyd mayweather?? cos dis guy money dey smell make una c
wait e do


dis boxer champion wey him name na floyd mayweather come dey show off him ogbonge cars
chai! dis guy get money sha...no b small money o..
d white bugatti na 2.5 mill dollars for market o while d rest two na 1.5 mill dollars
incase u wan rest d full tori make u press here
__________________________________________________________________________

4. na wa o dis oga govanor na real guyman see waitin e do

hmmm na wa o dis govanor na real guy man see as e dey road like our police
wey dey like 20 naira...
make u press here if u wan c more foto
__________________________________________________________________________

5. oga presido say dem no suppose dey call 9ja poor country base on say
baba God bless us


as we dey party for d 45th annual conference 4 d skool of accountant for abj na
him our presido come dey yan us say him go put all him muscle
take push corruption comot for we country him come still talk say
make dem no dey count we country among d poor country again say baba God bless
we wella....
make una press here to here d complete tori
___________________________________________________________________________


HOW UNA SEE D TODAY TORI NA??ABEG MAKE UNA TALK O I GO HAPP WELL
WELL TO C UNA COMMENT O

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related forums
UCL: It’s going to happen – Tuchel reveals Bayern Munich player that’ll score against Real Madrid
Forum | 4 days ago

UCL: It’s going to happen – Tuchel reveals Bayern Munich player that’ll score against Real Madrid

Nothing Must Happen To Me, My Grandson, And Mohbad’s Wife - Mohbad’s Mother Cries Out
Forum | 2 weeks ago

Nothing Must Happen To Me, My Grandson, And Mohbad’s Wife - Mohbad’s Mother Cries Out

What Will Happen If You Don’t Mind Your Business – Yemi Alade Slams Trolls
Forum | 2 weeks ago

What Will Happen If You Don’t Mind Your Business – Yemi Alade Slams Trolls

The Walking Dead Animated Series Can’t Happen Yet for This Reason
Forum | 2 weeks ago

The Walking Dead Animated Series Can’t Happen Yet for This Reason