Aproko News Gather: See All Top News When Happen on 01-09-2015 Ooooh!!

Forum 8 years ago

Aproko News Gather: See All Top News When Happen on 01-09-2015 Ooooh!!

Una welcome to to anoda episode of "Waploaded Aproko Daily Recap"
on the news today ,is your favorite boy,no 1 Waploaded aproko aka
Don jazzy accountant,aka cuteboi aka rugged guy

ehn! make i use dis opportunity take wish una happy new
month base on say e no easy to do waka waka den dey alive to c dis
new month na Jah we go tank o...so una happy new month o......


Our headlines today na:
1. FOTO OF OUR OLD STRONG MEN 4 9JA

2. LOLZZZ OMO I NO FIT LAF O SEE YABBING 4 D DON

3. D 402 CITY POLICE COMMAND SAY MAKE I TELL UNA SAY DSS NO ARREST ANY BOKO HARAM OO

4. MAKE UNA SEE SOME OF THE FOTO WEY WE GET 4RM D IB CITY PIKIN PIKIN BABY GBEDU

5. kia na wa o! MAKE UNA SEE DIS LANDLORD FOTO WEY BURN HIM TENANT 3 YEARS OLD PIKIN FOR OGUN

oya d tori in full


1. FOTO OF OUR OLD STRONG MEN 4 9JA



see some of the foto wey we get from d swearing in party of d NEW SGF
,NSA & ADESINA WEY ALL DEM D STRONG OLD MEN FOR 9JA POSE FOR D FOTO...
BUHARI D PRESIDO,VP Osinbanjo, secretary to d government of 9ja ,
Babachir Lawal;National Security chairmo,maj. Gen. Babagana Monguno
[wey don retire] Special adviser on Media and publicity, Femi adesina
and d ordas na him dey d party n d foto
see more foto


if u still wan see d orda fotos make u press here
_________________________________________________________________________________________
2. LOLZZZ OMO I NO FIT LAF O SEE YABBING 4 D DON

lolzzz i no fit laff o.. today i just dey do my aproko for instagram dey
go o na him i c waiting don jazzy d ogbogen oga of one record label wey
dem dey mavin upload o..no be small yabbing o..make u c waitin him fans dem
tell am for urself
make u press here
__________________________________________________________________________________________________
3. D 402 CITY POLICE COMMAND SAY MAKE I TELL UNA SAY DSS NO ARREST ANY BOKO HARAM OO

for Enugu city wey we still know as 402 city d police command come dey talk
today say waiting DSS dey para for on the 30-of last month say dem arrest 12
badt guys wey b boko haram say na lie dem dey lie o..
buh na wa for this dem dss o..y dem go dey lie lie na??abi dem wan dey feel like superman??
incase u u wan read all d lie lie tori make u click here
__________________________________________________________________________________________________
4. MAKE UNA SEE SOME OF THE FOTO WEY WE GET 4RM D IBsiti CITY PIKIN PIKIN BABY GBEDU

na today dem host d party of d pikin pikin of d governo of oyo state for ibadan...
d pikin of d governo wey her name na abisola n her hussy wey we know as kola kola-daisi
dey expect new pikin na him today her sisters n her padi dem come surprise her with
special party for d pikin wey dem dey expect incase u wan c deir fine fine face make u
press here
__________________________________________________________________________________________________

5. kia na wa o! MAKE UNA SEE DIS LANDLORD FOTO WEY BURN HIM TENANT 3 YEARS OLD PIKIN FOR OGUN

i hear say for ogun state police command arrest on wicked landlord wey him name na joseph olaleye
say he kill one of him tenant wey him name na abdulahi razaq pikin wey be 3 years
for owode ijako ota for ado odo otta LGA ON 30 monday last month

all dis tinz happen becos say d bad landlord n d pikin papa get qwata wey d landlord use
kerosine stove wey get fire dey take stone d small pikin n now d pikin don die as dem rush am
go one hospita wey dey near d area..the commissioner of police na na mistake den he come say
make dem carry d mata go court immediately dem don finish d search search..
abeg waiting dem wan do search search for na if no be say na one tin one tin dem
surpose f d man sharply...
d man come still wey glo shirt chai!

incase u wan read d complete tori make u press here

_________________________________________________________________________________________________

HOW UNA SEE TODAY TORI NA??? ABEG I GO APPRECIATE UNA IF UNA DROP ANY COMMENT O...
I GREET UNA O...we go dey see tommorrow na make una shine una eye o..una gudnite i still remain
d gallant apkroko of waploaded

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related forums
UCL: It’s going to happen – Tuchel reveals Bayern Munich player that’ll score against Real Madrid
Forum | 4 days ago

UCL: It’s going to happen – Tuchel reveals Bayern Munich player that’ll score against Real Madrid

Nothing Must Happen To Me, My Grandson, And Mohbad’s Wife - Mohbad’s Mother Cries Out
Forum | 2 weeks ago

Nothing Must Happen To Me, My Grandson, And Mohbad’s Wife - Mohbad’s Mother Cries Out

What Will Happen If You Don’t Mind Your Business – Yemi Alade Slams Trolls
Forum | 2 weeks ago

What Will Happen If You Don’t Mind Your Business – Yemi Alade Slams Trolls

The Walking Dead Animated Series Can’t Happen Yet for This Reason
Forum | 2 weeks ago

The Walking Dead Animated Series Can’t Happen Yet for This Reason