Aproko News Gather: See All top News When Happen Yeaterday ooooh!!

Forum 8 years ago

Aproko News Gather: See All top News When Happen Yeaterday ooooh!!

Note: This new section introduced by waploaded, will hencefort be delivered by Admin "Cuteboi".

Una welcome to to anoda episode of "Waploaded Aproko Daily Recap"
on the news today ,is your favorite boy, no 1 Waploaded aproko aka cuteboi aka rugged guy.

Our headlines today na:


1. 45 9ja people don get luck for obodo oyibo

2. i hear say dem catch 1 chickala wit expo for her holy part

3. "go defend urself" na him wike yan Amaechi

4. omo see gobe!church people pursue pastor after e give one of dem belle

5. lolzz cossy orjiakor say she dey find husband o abeg una help her see one?!

oya the tori in full


1. 45 9ja people don get luck for obodo oyibo



Dem say 4 obodo oyibo dem give 45 9ja guys power make dem study post grad. course 4 many many uni
for 1 correct year for dat mata..chai dem do well o.

e go make tinx easy o abi waiting u reason?

how u check the tori na??
press here to read full

_____________________________________________________

2. i hear say dem catch 1 chickala wit expo for her holy part



Omo see gobe them say dem catch 6 chickala wey one of dem na final year student for south coast
4 delta state uni, abk last friday with expo base on say men don
tear eye... all way na way oo

press here to see full tori
______________________________________________________________

3. "go defend urself" na him wike yan Amaechi



Wike come dey yan amaechi say him find way wer be say him go clear himself
base on say beef dey ground say him no go show for court

press here now now to see the Gbegeh!!
______________________________________________________________

4. Omo see gobe! church people pursue pastor after e give one of dem belle



omo yawa don gas no be small tin o wey happen sunday for united methodist church 4 oshodi
area of lag as dem members of the church pursue pastor comot for
church after him give him house gal belle.
i hear say dem be sack d pastor barkuma andrew 6 months before
after him give him house gal grace belle den she come dey get wahala
after she comot d belle...........

press here make u feel the real Gist
________________________________________________________________

[ads4]
5. lolzz cossy orjiakor say she dey find husband o abeg una help her see one?!



Dis gallant actress wey carry beta tin wey her name be Cossy orjiakor don make d mata cast say she dey
look for husband...

d babe say notin do her upon all d badt play wey she dey play
she even call "highness 4 spirit" wen she dey yan ovwe medeme

she yan many many tori wey go burst ur head, she even yan about her waka waka, marraige n some orda tori

incase if una wan read the full tori make una press here


Thanks for joining me today, on the Waploaded top aproko tori gather, join me same time 8:30pm tomorrow.

Abeg: My fellow brothers and sisters, make una put mouth for any of the tori above, just drop something via the below box, i go reply u immediately.

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related forums
UCL: It’s going to happen – Tuchel reveals Bayern Munich player that’ll score against Real Madrid
Forum | 4 days ago

UCL: It’s going to happen – Tuchel reveals Bayern Munich player that’ll score against Real Madrid

Nothing Must Happen To Me, My Grandson, And Mohbad’s Wife - Mohbad’s Mother Cries Out
Forum | 2 weeks ago

Nothing Must Happen To Me, My Grandson, And Mohbad’s Wife - Mohbad’s Mother Cries Out

What Will Happen If You Don’t Mind Your Business – Yemi Alade Slams Trolls
Forum | 2 weeks ago

What Will Happen If You Don’t Mind Your Business – Yemi Alade Slams Trolls

The Walking Dead Animated Series Can’t Happen Yet for This Reason
Forum | 2 weeks ago

The Walking Dead Animated Series Can’t Happen Yet for This Reason